Psalms. 142. David Song Wen E Dey Hide I kry to God! I dey beg make E kom help mi. I tell am all my komplain and trobols. Wen I nor get pawa again, na-im dey protet mi as I dey waka. Bikos anywhere wey I dey go, my enemies don set trap dey wait for mi. I dey look for di rite pesin wey go kom help mi, but nobody dey even tink go my side! Nobody to help mi; nobody even kare about wetin go happen to mi. Den I pray to Yu, my Oga God kon sey, “Na Yu dey guide mi. Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life. Make Yu hear my prayers, bikos I don taya. Make Yu save mi from pipol wey dey opress mi, bikos dem too strong for mi. Bring mi kom out from prison, so dat I go tank Yu. Pipol wey dey fear God go kom gada round mi, bikos Yu dey good to mi.”