Psalms. 133. David Song Make una si as e dey good and wonderful wen God pipol dey stay togeda for peace! E dey bi like betta fine oil wey dem pour for pesin head, wey rush go en bear-bear. E rush go Aaron bear-bear and di holy garment wey e wear. E bi like di dew for Hermon wey dey flow from Zion hill. True-true, na der God for sey en blessings go always dey forever and ever.