Psalms. 121. David Song I go look up to di mountin! Where my help from dey kom? My help dey kom from God, di Pesin wey make heaven and eart! E nor go let mi kick stone fall; di Pesin wey dey guide mi nor dey sleep. True-true, di Pesin wey dey guide Israel nor dey sleep at-all at-all. Na God ensef dey wosh ova mi! E stand near mi kon protet mi. Di sun nor fit do mi anytin for day time or di moon for nite. God dey keep mi from my enemies and E dey protet my life. God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back! E go protet mi naw and forever.